Na wa o, Tori wey dey reach us be say, 92 pepo, plus including women and small small pikins dem na idem die for inside petrol tanker explosion for Rivers state today Thursday July 12th.
Di tanker na for Okobe for Ahoada West Local Government Area inside Rivers State na im e fall, come trowey di petrol wey dey inside in belle.
As pepo for di area see say di tanker fall trowey fuel and e nor catch fire, na im dem rush go di place go dey take plate pack di petrol, na for weir dem dey pack am na im di tin come explode o!
Rivers State polis talk talk persin, Ben Ugwuegbulam talk say na true say e happen, but dem neva fit talk di numba of persin wey die for inside di explosion.
Abeg my 9ja pepo, if una see say tanker fall trowey petrol make una nor go deir go dey pack petrol, na die o!
Talk ya mind!

The petrol vehicle was trying to avoid a head-on impact with vehicles when it swerved into the dump Friday day, said Estuaries and waterways State cops spokesperson Ben Ugwuegbulam. It then overturned, making its petrol to leak and people instantly swarmed to the landscape to gather some of it.
ReplyDeletewell,I can say, as a fireman, that when a fuel tanker splits open and burns, it burns very intensly. It doesn't usually explode. Look at the devastation and twisted metal that isn't charred. It looks like an explosion to me.
ReplyDelete