Di tori be say luxury bus wey carri sekondary schul gals wey dem schul be Holy Cross College, Enugu dey go Lagos com get wahala for Okeodo along Ore-Sagamu Expressway, Ogun State for Saturday around 11:40pm for nite, na im di driver park di bus say make im look wetin do di bus, as dem di gals dem dey wait make anoda bus com carri dem na im dem di robbers com attack dem.
Di robbers carri di bus enter inside inside bush, beat dem di gals, tiff dem mony, com even rape some of dem join.
Di students dem wey dem count for inside di bus na 42 gals and di bus wey dem hire na Ekene Dili Chukwu Group of Companies na im get am, di registration number na Lagos XW 875 LSR.
Na polis dem na im com torchlite di mata com trace di bus go see am for inside bush wey dem leave di bus na dem olis com helep di gals comot for di place carri dem reach Lagos.
Talk ya mind!
Tori aproko na Punch Metro
Tori aproko na Punch Metro

No comments:
Post a Comment