13 April 2012

Abomination: Broda Marri Im Sista Dem Born 4 Pikins !

Court for obodo oyinbo Germany don talk say e nor good make broda and sista make dem marri,  sake of say e nor good and say di kin pikin  wey dem dey born for dat kin marraige dem brain nor dey correct.

Di tori be say one man wey dey stay for Leipzig inside Germany carri case go court say wetin im do wit im sista nor bad, say nor be today,...una wan know wetin e do???

Di man wen dem born am, dem im pepo carri am give anoda pepo say  make dem take (adoption) as di man grow finish na im e hear say di mama wey born am true true don die.

Di man come go visit im bifor bifor famili na deir e come see say im get sista...nor do nor do, na im di two of dem com dey do love wantintin.

Dem di broda and sista com park entar one house com dey live like husband and wife sotay dem born 4 pikins.

Inside di 4 pikins 2 of dem di pikins nor complete for bodi sake of say dem papa and mama be broda and sista

Wetin di man still dey talk be say im and im sista dem nor know dem sef bifor and dem nor grow for di same haus.

Talk ya mind!

Tori aproko na HERE

No comments:

Post a Comment

Click Dis Button To Share 9japidgin Tori

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...