Wahala don dey arrange parti for late Dim Chukwuemeka Odumegwu-Ojukwu family, sake of say dem im pepo nor gree for di sharing formula wey dem wan take share im properti.
Even sef Debe, wey be di first pikin of late Dim Chukwuemeka Odumegwu-Ojukwu talk say di problem wey dey di famili bifor im papa die na wetin concern di big estate wey im granpapa lif dem.
Debe talk say case don dey for di properti wey im granpapa lif tay tay, say pepo for di family wan take di case gbege am make dem disturb im papa burial, but sha becos im nor want wahala, and im nor dey find trouble, im nor let di gbege disturb im papa burial, sake of say im respect im papa well well opon say di man don die!
Debe, don promise say veri soon im go open di pot wey dem take cook soup for haus, make pepo gader com count di meat wey dey inside .
Talk ya mind!

debe na 419 guy, i know im papa and im papa nobe ojukwu, them chase am away for nnewi when dem bury ojukwu, na 4 - 40 wey him run for nnewi
ReplyDelete