16 March 2012

Shine Ya Eye Fake Sugar Don Enter Market O!, NAFDAC

 NAFDAC don come out  hala say fake sugar don full 9ja market o!, say make pepo for 9ja shine deir eye well well make dem no go take deir mony buy wetin nor good.


Anslem Okonkwor, wey be one of  di talk talk  persin for  NAFDAC talk say na becos of di ogboge chuck eye wey dem do for Oyo state na im make dem talk am.


Even sef anoda oga for NAFDAC Mrs. Omosola Osibanjo, talk say wen dem hear say dem dey do fake st. Louis sugar for Agbeni market, inside  Ibadan for  Oyo state,  dey sell for  pepo, na im dem tier race go di place go scatter am, carri all di fake sugar troway.

Talk ya mind


          

No comments:

Post a Comment

Click Dis Button To Share 9japidgin Tori

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...