Na for Ilupeju Lagos State na im 2 haus gals dem wey deir name be Patience Okpara and Elizabeth Emmanuel begin dey figth becos of Indian man ...msheeeew(dem dis gals no get sense o!)
Patience vex for Elizabeth say she kolobi im... hnmmmm...... (una sabi na) even sef di india man na patience oga o! ....
Di tin wey pain Patience pass be say, wen she ask Elizabeth say wetin dey bring dis kin leg na, na im Elizabeth tell am say na becos she sabi do well well ,na im make Patience oga follow am do di tin... hnmmm....orishirishi... msheeeew .
Na im kasala com burst, Patience carri wata put for fire pour pepper inside make e cook well well com pour di hot wata for Elizabeth im bodi.
Patience na 25yars im be Imo gal ,Elizabeth na 25yars na Akwa Ibom gal.
Talk ya mind
Na PM News we kolobi di tori.
No comments:
Post a Comment