28 February 2012

See Wetin Polisman Do Im Galfriend!

Heeew!, Chineke!, Osanubuwa!, Olowun o!
My eye see somtin i begin dey cry, sake of say na human beans na im do dis kin wicked tin. If man no follow woman do again na fight!

Entertainment Express
Na for No. 12 Ifateludo Street, Bariga, Lagos na im dis tin for happen o!.Di polis man wey im name bi Emmanuel Okujo, wake up earli momor go di haus of  Blessing Isabor,  and im sista Patience Isabor, com comot gun begin dey shout say im go kill di two of dem, na im one small pikin wey see am run go met im mama say make e com see polis wey wan shot dem Blessing o! as di woman reach deir, na im e see di polisman okujo dey talk say im go kpai dem, na im dem com bigin dey beg am, say make im abeg make e forgive dem all di bad bad tin wey dem don do am, no do no do na im di polis man hala di woman wey dey beg say if e no comot for di room im go shot am join dem di gals, na im di woman scatter race begin dey hala for inside compound say make dem com see o!

Bifore pepo go reach deir, dem see say Okujo don shot Blessing for face carri im sista Patience run, na im kasala take burst.

Pepo for di compound tak say di polisman bi dey frend Blessing na im e comot eye for im bodi com dey frend im sister Pateince, say even if e no frend Blessing again why e com shot am carri im sista run.

Polis officers for Ifako Police division  com run go im haus say make dem go catch am na im dem see di man unifom and di gal cloth wey blood dey inside for im haus.For were di two of dem dey, dem neva know.

As we dey tak dis mata so! dem neva si di polisman and Patience o!
even sef Blessing dey for Lagos State University Teaching Hospital (LASUTH), Ikeja. Dem deir pepo dey cry sake of say mony no dey to take treat Blessing, even dem di dokita dem dey tak say na by di grace of GOD na im Blessing go take survive di gun shot!

Tak Ya Mind !

No comments:

Post a Comment

Click Dis Button To Share 9japidgin Tori

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...