![]() |
Brittani Niccole |
Na one man for obodo oyinbo wey do hapy baiday for im pikin as she take reach 18yars...
wetin una tin say di man gi am... BIG BRES...BIG BOBBY.
Di man na dokita wey dey turn persin wey fill say im worwor to fine gal omalicha nwan (plastic surgeon)
Di man talk say as im see say im pikin go soon reach 18 yars and im bobby no big reach im mate own, na im im kukuma say na BIG BRES im go take do di baiday for am, wetin surprise pepo pas be say na im take im hand do di operation give im pikin di BIG BRES.
Michael Niccole na im bi di man name, talk say bodi no do am any how wen im dey do di operation, even sef im don do operation for im sons,im wife, im cousins, even im papa!
Brittani Niccole na im bi the gal name talk say, di day wey im papa do di bres for am na im bi di day wey im no go forget lailai say she hapy well well.
Di papa talk say, “Im no dey change deir look, mba nu,” say. “na maintenance im dey do. say make dem no old.
Talk ya mind!

No comments:
Post a Comment